'I lose my job becos dem give ChatGPT credit for my brain work'
- by BBC
- Apr 09, 2024
- 0 Comments
- 0 Likes Flag 0 Of 5
End of Recommended articles
"As time dey go on, I go write articles from my brain for different topics and my direct oga go tell me say dem don flag am for AI. I go rewrite di articles up to four times even though I sabi say wetin I bin write no be from AI but dem go still flag am. Di mata frustrate me die as I dey work for dem cos e be like say I lose my credibility. And las-las, e end say dem sack me."
Dis mata bad sotey, she by herself, anytime she dey do dia work, she get like four AI checkers wey she dey take cross-check her work so dat e no go be like say she use AI. But dem go still flag am for dia end becos, according to dem, di AI checker wey dem bin dey used dey paid for so e dey more accurate.
Plenti pipo weda codedly or in open dey use AI either as research tool or to helep dem write for either academic purpose or for dia work.
In fact, Akinwande wey also dey do remote work say ChatGPT dey help am wella for di kain automated and fast paced work e dey dey do, E say, "wit my work, we dey use AI bicos of di kain work we dey do and di speed wey we suppose deliver to our oga at di top. We dey use am as template or fil up idea, as e relate to di kain project we dey work on."
Im sef notice pattern on top how Chat GPT dey take repeat some kain words from certain prompts around im work wit social media, so according to am, na to edit di work to sound more human and less "robotic".
For social media, pipo don dey tok more and more about di words wey dem dey take determine say pesin use AI or Chat GPT write wetin e send give dem.
Skip Twitter post, 1
Please first to comment
Related Post
Stay Connected
Tweets by elonmuskTo get the latest tweets please make sure you are logged in on X on this browser.
Sponsored
Popular Post
Tesla: Buy This Dip, Energy Growth And Margin Recovery Are Vastly Underappreciated
28 ViewsJul 29 ,2024