ChatGPT back online afta global outage
- by BBC
- Jan 23, 2025
- 0 Comments
- 0 Likes Flag 0 Of 5
23 January 2025
ChatGPT don begin work again afta one down-time wey see di world best-known artificial intelligence (AI) tool go offline.
Downdetector, wey dey track website outages, show say more dan 10,000 pipo bin report di AI chatbot, wey OpenAI make.
Users wey try to access am bin receive message wey read "di web server don report bad gateway error".
OpenAI on dia status page at 15:09 GMT tok say dem don begin work on am, and add say di firm dey "monitor di results".
Many pipo don enta social media to highlight di problem and di disruption e dey cause dem.
Di downtime start around 11:00 GMT on Thursday, and users kontinu to report issues.
Meanwhile, di company on Thursday report di issue on status page say dem dey "currently experience elevated error rates in di API" and say dem dey investigate di problem.
Though many pipo dey use di free version of di chatbot, di firm dey charge up to $200 per month for dia various membership tiers.
OpenAI boss Sam Altman for December tok say more dan 300 million pipo worldwide dey ChatGPT weekly. Wia dis foto come from,
Getty Images
ChatGPT na chatbot wey OpenAI create and one of di popular AI sites wey pipo dey use.
Chatbot or software application wey fit engage in conversation weda in writing or voice.
ChatGPT fit to write essays, scripts, poems, and solve computer coding like say na human being. E even fit admit mistakes!
ChatGPT na Artificial Intelligence Technology chatbot wey OpenAI company found and launch for November 2022.
OpenAI na artificial intelligence research firm wey im founders include Elon Musk.
Artificial Intelligence (AI) Technology chatbots dey designed to answer questions and find information. ChatGPT na di best-known example.
E fit write essays, scripts, poems, and solve computer coding as human-like way. E fit also do conversations and admit mistakes.
Di GPT stand for Generative Pre-Trained Transformer. Dis mean say e dey learn wetin to tok by capturing information from di internet.
E go come use all of dis information wey e gada from di internet to "generate" responses to questions or commands wey pesin ask.
Millions of pipo don dey use ChatGPT since dem bin launch am for November 2022.
ChatGPT dey answer questions using natural human-like language, and e fit also mimic oda writing styles like songwriters and authors, using internet.
But concerns dey ground say e fit one day take ova many jobs wey human being dey currently do.
Topics Wey Dem Resemble
Please first to comment
Related Post
Stay Connected
Tweets by elonmuskTo get the latest tweets please make sure you are logged in on X on this browser.
Sponsored
Popular Post
tesla Model 3 Owner Nearly Stung With $1,700 Bill For Windshield Crack After Delivery
33 ViewsDec 28 ,2024
Middle-Aged Dentist Bought a Tesla Cybertruck, Now He Gets All the Attention He Wanted
32 ViewsNov 23 ,2024